Home Pigin As Una See me So, My Second Name Na Focus and Hard...

As Una See me So, My Second Name Na Focus and Hard work- Tebo Franklin

40
0

Nasarawa United defender Tebo Uchenna Franklin don open mouth again to take clear talk say en still de focus even as en don grab numba 5 NPFL Man of de Match Award afta Nasarawa go run Wikki Tourist FC street for dia home as !dem collect tiri ponkwe straight from Bauchi boys hand for inside NPFL MatchDay 21.

De former FK Vitosha Bistritsha defender of de universe talk say notin concern am pass make him continue to de work hard achieve for inside diz Futball career afta dem beat Wikki 2-1.

Tebo say as e be so, say nah focus and hard work be him second name as en wan be part of players wey go make en club reach top top for de league.

Naija Sergio as plenti pipu de call am come yarn Tori pipu for beta English say:

“My aim for the rest of the season is to stay focused and determined. I’m not going to get distracted by the many MVPs picked up so far.”

E arrange talk join say for am, de only tin wey de important pass for am, nah make season pure for dem like beta cold pure Haven wine wey de kulele person soul.

Laslas Tebo wey sabi shame for front of camera con close talk say, “Our resolve as players is to finish the season strong, he said. We won’t relent in the bid to make hard work and consistency our watchword”.

As de matta be so, Governor A. A. Sule Boys don sidon numba 5 on top NPFL table, as dia aim nah to go play continental like dia senior broda Enyimba Fc of Aba.

LEAVE A REPLY

Please enter your comment!
Please enter your name here