De head coach of Plateau United Coach Abdu Makaiba don come out to say dem no ready to stop to dey win matches as him boys moral don climb up afta dem clear Nasarawa United doubt wit 1-0 win for NPFL match day 7.
Lanlong Boys wai shock de Solid Miners boys for 36 minutes as Mohammed Zulfikilu cum carry beta nodding chuk ball put for inside Nasarawa United net .

Coach Makaiba wey hapi say him boys waya dia neighboring visitors con yarn tori people after match say.
“I feel excited to have won the game against Nasarawa United. Any game against Nasarawa United is a derby and always a difficult game to play”.
As Coach Maikaba continue to dey yarn tori people, him say him belle full with wetin oyibo people dey call excitement say dem collect all de 3 points wey be the only plan wey dey carry go enter the match.
“With three points in the bag and three points behind Nasarawa United on the summit, we wont relent but its my believe we are getting closer while the team will continue to improve”.
Makaiba con conclude talk says, Him go take each game as e cum wit serious face. “so the next one against Warri Wolves is not going to be different. We are going all out to make sure that we get our first away win of the season as it will catapult us to top three on the log.”
As e de hot so, Warri Stadium go be centre of ogbonge action as Plateau United go face Warri Wolves for match day 8 fixture.