Notice: Function add_filter was called incorrectly. Filter for "amp_is_enabled" added too late. To disable AMP, this filter must be added before the "plugins_loaded" action. Please see Debugging in WordPress for more information. (This message was added in version 2.0.) in /home/queenkad/public_html/newscourt/wp-includes/functions.php on line 6085
CAF Party Scatta: Olisema Goal Don Push Enyimba Enta Quarter-Final – Queen Kada News Court
Queen Kada News Court

CAF Party Scatta: Olisema Goal Don Push Enyimba Enta Quarter-Final

Enyimba don put plenti ogbonge joy for pipu bodi as olisema Cyril last minit shot scatta Orlando pirates net to take walka witi full chest enta quarter-final of CAF Confederation Cup.

Naija pipus Elephant for almost end of match finally come get betta chance take finish work against pirates to take enta list of doz wey go play de next round for CAF Confederation Cup.

De aba mafias sidon well for de game as dem hold ball pass unbeaten southi boys wey no go even loose anytin if dem no win de game as dem balance well for de group table.

Plenti plenti times inside de match Anayo Iwuala,Samual Oruk and Victor Mbaoma try dem best make dem for scatta dia visitors net witi hot hot goals for bot first and second half but de tin no enta for dem before laslas door come open for olisema for inside 5 minit wey dem add to take cut pirate ticket witi goal wey sweet pass hausa alewa(Lollipop) wey de stain mouth.

As be so bot Enyimba of Naija and Orlando Pirates of South Africa don qualify as two of dem hold 9 ponkwes to take enta next round wey be serious knock out tinz.

By Friday Enyimba go know who dem go knock out for quarter-final like how kamaru Usman knock out Jorge Masvidal UFC.

Exit mobile version