De deputy Governor of Edo State, Honourable Philip Shauibu don come out say en comot cap for our Ogbonge minister of youth and sports development Mr. Sunday Dare as en carry life choke inside principal cup mata wai bin don die tiatia.
His excellency, Oga Philip witi plenti joy for inner mind yarn people as dem tear open ceremony say ” I want to use this medium to thank Mr. Sunday Dare for reviving the principals Cup.
Oganla Philip come shock people again say, en sef bin play diz principal’s cup competition doz days wen him dey secondary dat year for Kaduna and as e be so bodi de sweetam to be part of de people to attend after many years of silence.
As belle come able Edo deputo reach en come add say diz principal’s cup settings make brain well well , diz wan Don show say Mr. Sunday Dare know en work well as minister, as diz en vision for sports de make sports for Naija don de make brain.
Na so en con Laslas add for de matter say “Sustaining this National Principal’s cup is a pointer that we can produce more talents for the country”.
As e be so naija pipu de happy say, principal’s cup don show back as many de see am as beta opportunity make dem discover good talent wai fit represent us for Naija .