Wahala no dey finish for son of man as TM of Nasarawa United Oga Solomon Babanja don enta serious wahala wit League Management Company (LMC) as dem charge am for wearing foreign jersey come league game.

Quick quick LMC lawyer dust framework book sharp sharp open am say oga Solo don break C1.4 of the NPFL Framework & Rules wai talk say club officials must wear correct clothes (official club clothes , corporate or business attire) de mata be say TM forget nack FC Nantes of France Jersey wai fit en bodi well well bounce go run show for league match no know say de tin go cast for am.
De sweet tin bi say, no bi only Oga Solo dem catch too oo for agbala dressing , Katsina United coach Baldwin Bazuaye sef enta one chance wit LMC as en own mata choke pass .
Coachito shock everybodi including LMC for matchday 9 Akwa United vs Katsina United as baba jus appear match venue like Tupac wit tear tear jeans con Sidon for chair de run tinz.

Naso himsef con follow breach Rule C1.4 of NPFL Framework and Rules as LMC clear en mata straight.
Dem Don warn oga Solo Babanja and Katsina head Coachy make dem bi good example to odas Ooo, but en no go change mata say dem go still serve dia punishment for using dia hand to tak scratch de bodi of NPFL Framework.