Oyinbo club for Spain SD Huesca don strong mind finally end dia business witi Super Eagles midfielder Kelechi Nwakali upon say en contract near reach to end .
Nwakali since after Africa Cup Of Nation 2021 wey en return back en club , never see one match play becos some kind small small mattaz wey de ground between him and de club.
De 23 years old player wey Captain U-17 FIFA world cup squad , join de second division team for 2019 witi 3years contract wey suppose come end diz June, jus come collect sack letter from Huesca say dem no need am again for dia team.

SD Huesca wey use dia official media channel take announce de news say dem don close contact witi Nwakali still come wish well as en de leave dem .
Before now de club been comot complain one time say en no gree resume back to de club on time after Naija comot for AFCON en take like 2 extra weeks before en show , so for dat dem go take some kind disciplinary action for de matta.
Make we no forget say Arsenal been sign am ,before dem come loan plan out to clubs like VVV Venlo and Porto B ,before dem free am wey SD Huesca see am buy for 2019.
As be so Kelechi Nwakali de talented son of Grace as dem de call am , don be come free agent , so any good club now fit go price en market ,as we de wish am de best for en football career.