De Benue Top sports strongman Oga Mike Idoko don open up talk say en support still dey gidigba for Lobi Stars of Markudi even as dem tell am to step aside as vice club chairman for Lobi.
Oga Idoko don come out tell pipu wai like de club well well, bot for Ogbodo oyinbo and inside Naija say make dem no tiya to de support de team anytime, anyday even as en no dey dere again.
Idoko wai be administrator wai sabi work well and don tai for football matta con release talk witi tori pipu to take clear air propa propa for de matta say:
“It is true I’ve stepped aside from my position at the club as instructed. Lobo Stars is a big institution, it is our team and we must do all we can to support it whether I am there or not”.
“The journey has been challenging and I’ve done my best to serve the club and will continue to do so irrespective of where I am.
En still choke yarn say, “What has a beginning must have an end. My chapter as chairman of the club has ended but it does not mean I won’t continue to support the club.
Oga Idoko con Laslas finish matta say, “I urge all the fans both home and abroad to continue supporting the team. I’ve also spoken to the players to continue to work hard and give their best to take Lobi Stars to greater heights.”
Make we no forget say oga Mike Idoko carry Lobi stars of Markudi go reach CAF Champions League group stage for 2018 afta sidon as numba 1 for Nigeria Professional Football League(NPFL) table before don Con stop de league dat year due mattaz arisen dat time.