As Naija Proffesional Football League (NPFL) don de small small near to close curtain for the season , na so all man de try de arrange en house make dem for no pushu dem go meet dia juniors (NNL) wen season finally end for diz 2022.
As de league don enta crucial round, all club dem don de struggle to tidy dia house make e no do dem like India movie wey cry plenty inside wen league finish .
As we all know say many many tins dey happen for inside NPFL matchdays, as e be so, we wan look wetin shele inside Matchday 24 as we get informate say some teams collect am wotowoto, both for away and dia backyard too oo!
As matter dey hot hot reach, make we run am down for una make una take eye see and read wetin happen for inside Matchday 24 for NPFL:
Akwa United vs Nasarawa United
What God cannot do does not exist oo!!! Akwa United don plaster Nasarawa United mouth witi poto poto(mud) for inside Matchday 24. Diz match choke die oo!! as Akwa United fire Solid Miners (Nasarawa United) 6 good goals for inside 90mins ,even as say Nasarawa try score 1 goal , dem still collect wotowoto for Akwa hand . De match end 6-1 for Promise Keepers’ (Akwa United) favour.

Niger Tornadoes vs Rangers
Dis game bin wan almost tie wrapper for Niger Tornadoes as de game been de run 1-1 for long, as game don de near small small to end naso Niger Tornadoes come get penalty take get security goal wey give dem better victory against Rangers Int’l of Enugu, de game end 2-1.
Lobi Stars vs Gombe United
Diz game hot like pepper soup with plenti Cameroon pepper inside, as Lobi de battle make dem no draw dia leg go back Egypt (NNL), dem fight to make sure say dem no let Gombe United collect any ponkwe for dia home as de game end 2-1 for Lobi favour.
Remo Stars vs Dakkada FC
Remo Stars for dis match , just make up dia whole mind witi full chest as good hosts wey dem be, say dem must to serve Dakkada Ikenne tasty sharwama chop 1 and get 4 free, before Dakkada go close eyes open for 90mins dem don collect better 4 goals , Dakkada try manage struggle score 1 goal make e no be say dem no patronise dia rival for dia home. Still game end 4-1 for Remo Stars favour.
Kwara United vs Abia Warrior
Harmony Boys (Kwara United) dis time sweat no be small for dia home as e bi say dem wan loose wrapper comot for dia waist inside dia house . Abia Warriors take vex to come collect point for away bcos dem sef dey struggle make dem no go back class 2(NNL). Notin wey Kwara no do to secure 3 points but Abia Warriors carry rope tie everywhere strong strong. Las las na so dem share points. At all at all na him bad pass, 1-1 na so de game end.
Katsina United Vs Shooting Stars
Katsina United for MatchDay 24 comot shame take wipe Shooting Stars of Ibadan better 3 goals after wetin dem suffer Agberoism(Hooliganism) for Kano Pillars hand for Matchday 23 , unto say shooting try score 1 goal, e no shake anytin sef as Katsina United balance well collect dia tiri points for home . De Game end 3-1 for Katsina United favour.
MFM vs Wikki Tourists
Chaii!!! This game pain pesin enter bone. As Wikki Tourists get mind reach remove small relegation Akpati(stool) wey MFM Sidon on top witi high hopes say miracle fit happen , Wikki jus comot de Akpati put better mat instead ,make dem for lie down inside relegation house well well. You know say if u sidon for on top stool, you fit stand up ,but witi mat na to lie down oo… This Game end 0-2 as Wikki Tourists of Bauchi collect all de 3 points without pity at all. hmmm!! As e be so MFM don change song From dia regular ‘Yaweh’ to ‘Only Jesus Can Save’.
Heartland FC Vs Plateau United
This game na game wey many people say na ‘Grace Derby’. Dem talk say grace de follow dey head coach of Plateau United Fidelis Ilechukwu anywhere en go , but diz time grace no come favour plateau United as dem run dem street for Owerri. Heartland collect dia 3 points witi struggle, as game end 1-0 , wey favour Naze Millionaires (Heartland).
Sunshine Stars vs Rivers United
You see dis game, plenti people think say Rivers go take water wash Sunshine comot for road , as dem go do for Kastina home nah. Rivers wey dey on top de league table so far witi better unbeaten run record come collect sun wey dry water for dem as game end 1-0 for Sunshine favour .
Enyimba Int’l vs Kano Pillars
People’s Elephants (Enyimba) kuku don damage concrete pillar wey Masu Gida (Pillars) dey take support dia sef for inside relegation zone , dem collect 4 goals straight from beginning to end of 90mins as Enyimba take vex brush brush dem for de game wey end 4-0 for Enyimba favour .As be now Kano Pillars dey seriously battle make dem no sink enter relegation for end of season.