As League don de hot de go like Ghana pepper inside palm oil stew, all clubs don de arrange dia sef for Match-day 10 to tackle each oda hot hot make dem for hold points based on who dem be.
Make una check unda to see who go face who dis time around for NPFL MatchDay 10.
PLATEAU UNITED VS RIVERS UNITED
Plateau United sopos face Rivers United but den shift de match as Rivers get to play CAF Confederation Cup against Enyimba for Aba.
NASARAWA UNITED VS AKWA UNITED
Solid miners (Nasarawa United) go drag am dis time for Lafia wit Promise Keepers(Akwa United) make we see dis time weda dem go correct watin Enyimba take dia eyes see Las time.
KATSINA UNITED VS JIGAWA GOLDEN STARS
Dis one nah house mata, as Katsina United go face en broda Jigawa Golden stars for inside Katsina house, make we de see weda dem go share tiri points witi dia junior broda or dem go tight hand for family meeting for inside field today.
ADAMAWA UNITED VS FC IFEANYI UBAH
Adamawa United go jam head wit dia relation from east Ifeanyi Ubah for dia home, diz match eh! go hot like porridge beans for fire as Adamawa wai de bottom buttom for table de find how to take climb up diz time and Ifeanyi Ubah sef dey inside hot water join for buttom.
KANO PILLARS FC VS MFM FC
Diz Valentine go red well for Kaduna as Mai su Gida boys de prepare to face Olukoya pikins(MFM) for Dia home , de tin be say Mai Su Gida boys go wear yellow and green to show say dem no come to do love for inside field while we neva know who go carry MFM come play this ogbonge match as them Ogas don troway their papers within the week.
HEARTLAND FC VS LOBI STARS
Heartland FC go welcom dia Benue brodas Lobi Stars of Markudi for Owerri diz time. Hope dem go write numba diz time put Jersey make we for know who de play and try make people know say wetin dem do MFM for Lagos no bubuyaya.
WIKKI TOURIST VS SUNSHINE STARS
Wikki Tourist of Bauchi go host Sunshine Stars of Akure for dia house, as e be so Wikki de find how dem go cova sun make e no shine on dat day for dia home.
KWARA UNITED VS DAKKADA FC
Kwara United pepper dem geng go roll am witi Dakkada FC for Kwara, de mata be say all eyes de look as oyinbo Brazil Lucas go show leg for match day 10 diz time around .
ABIA WARRIORS VS ENUGU RANGERS
Hmmm!! Diz wan be like clash of de titans as Abia Warriors go battle bot spiritual and fisical against Rangers FC of Enugu. Diz wan go tight as we know say Abia Warriors de dance Awilo logunba unda for relegation zone.
WARRI WOLVES VS ENYIMBA
Dis match no go hold as LMC don push am go front small, since Enyimba go play CAF confederation cup against Rivers United.