Home NPFL NPFL MatchDay1 Fixtures: Nasarawa De Arrange Table To Serve Enyimba Breakfast, As...

NPFL MatchDay1 Fixtures: Nasarawa De Arrange Table To Serve Enyimba Breakfast, As Akwa Don Collect Dia Own MatchDay1 takeaway From Bendel Insurance

73
0

De Naija football professional league don set propa propa to start de 2022/2023 season,make we no forget IMC declare say na abridged league clubs go play dis season, make dem fit for meet up the football calendar.

As dem de talk am say “Na who stand Strong ,Go see front well ” naso e go be dis season na who balancia well go sidon kamkpe for top.

Make we no forget IMC and plus dia committee for referee mattaz don promise us say dis time, dem no go give chance for usual wuruwuru and abracadabra doings wey de always happen for inside we league .

Make we also remember say Akwa United don chop dia own league opener breakfast, as mattaz stand na for MatchDay1 , that same God wey do for dem date year wen dem win League , dis time come allow Bendel people serve Promise Keepers 2 cup of tea witout bread (0-2) for Akwa Home chaii!!! .

As season de blow de come dis weekend, all teams blood de boil as dem de aim dia fess 3 points for the season opener.

Make una take eyes look fixtures for the NPFL Matchday1 as e de catch fire:

Sat Jan, 14th

• Enugu Rangers vs Abia Warriors 4pm (South-East Derby)

• Nasarawa United vs Enyimba Int’l 4pm

Sun Jan, 15th

• Bayelsa United vs Dakkada 4pm (South-South Derby)

• Doma United vs Sunshine Stars 4pm

• Kwara United vs Gombe United 4pm

• Plateau United vs Shooting Stars 4pm

• Remo Stars vs El-kanemi Warriors 4pm

• Rivers United vs Lobi Stars 4pm

• Wikki Tourist vs Niger Tornadoes 4pm

Note: All time are in Nigeria Time (+1 GMT).

We wish all de teams better luck as serious battle go start for who go be Oga for the end of 2022/2023 NPFL season.

LEAVE A REPLY

Please enter your comment!
Please enter your name here