Naija skillful goal machine Saqid Umar, don show say en be baba for dem all for inside pipu wey de score beta beta goal pass for en club as e net en goal number 15 when Almeria nack Malaga tiri pondo for dia home.

Sadiq Umar witi en team mate dem sidon for dia opponent throat like fish bone de Choke dem with beta shot sote Malaga kuku tiya for de matta, na so en team Almeria fire dem 2-0 for first 45 minutes.
As second haf enta road de go, Almeria begin press Malaga like fresh agege bread wai yeast de body well, immediately Sadiq see beta chance, na so e clear am enta Malaga net in de 77mins to make am 3-0 for dem.
As be so, Sadiq eyes for goals be like 3D glasses, e de see net well well to score. Witi dis 3 points so, Almeria don sidon as numba 2 on top table witi correct 60 ponkwe Spanish second division league .