According to de notice paper wey Chief Operating Officer of league bodi, Oga Salisu Abubakar sign , say matches wey dem don shift nah Matchday 22 of Match Numba 216 Akwa United and Rangers International F.C of Enugu.

De match wey dem suppose play for 24 May, 2021 don shift to 25 May 2021. Even Match Day 23 of Number 226 wey connect Abia Warriors and Akwa United wey dem suppose play too for 26 May don waka go 27 May for Okigwe Township Stadium.
De match day 23 witi Rangers International and Jigawa Golden stars follow don Shift from 26 May go 27 May, Jigawa Golden stars wey suppose drag am witi Abia Warriors for Matchday 24 on 30 May don shift go 31 May.
LMC add mouth say na bcos logistics mattas get as e be diz time and e come join witi television coverage too. As be so dem don advise all de clubs, say make dem follow Covid – 19 protocols witi strong hand or else e go choke for dem.