Chai!! garri don swell pass water as Dreamstar senior Coachy Anya Ugochi don waka Comot for dia club as bodi no sweet her again for dia mata.
Even as belle de totori her say senior women league for Naija go start again, Anya still cry say de ogas at de top for dreamstar no de do her well at all, dats why she kuku pack her potumantu waka comot leave dem.
Coach Anya wai yarn wit tori pipu talk say, “The management no dey carry me along and no respect my opinion, so I kuku waka comot”.
She complain bitaly say dem no de square her beta money at all , no salary, na soso small small change dem de give her wai no fit kip bodi and soul togeda sef, instead nah so so bring result, bring result dem de find , wen money no de work to ginga her morale . As dem ask her how bodi do chairman wen she clearam say she wan waka? Coachy say , “The chairman no send any body , because he no wan spend money but he want result.”
“When I ask for the paper way go tell me my position my position as the head coach, he come write my say my position nah acting head coach, because he wan pay 20k monthly allowance way I never see January own sef.
When the club relocated to Ejigbo, their family house, he did not think of how I could be meeting up with trainings. I spent all my money on T-fair just because I want to continue. But since he has shown that I’m on my own, I called it a quit,” .
Coachy con clear tori final final say , “I didn’t pick my advanced certificate and CAF C license that am using to work for him from the gutter, I obtained them with big money and hard work so I will not use it for free”.
As NWFL don get February 10, 2021 to start knock ball again, Dreamstar Ladies go need find new coachy as e don bi for dem so, before e go bi like morning wai no gree break wen league continue.