Wahala don ride bicycle go Lokoja as Kogi United players don go block governor gate for wetin dam call peaciful protest for money wai dem dey owe dem for long time now.
As de tin pain dem enta bodi, na so all men get up con assemble demsefs carry dia placards begin match go governor house, make dem for go cry put for His Excellency ear weda sometin go happen for dia mata as e don red for all men.
As boys eyes don change color, na so dem tear head say dem no go play league as e be say NNL 2020/2021 season go start 13th of February ,say if dem no pay dia money, say all man go sidon en papa house wen league start till dem pay dem dia money complete.

One player wai de tin vex enta blood well come tell tori pipu say: “We want to be paid our two years sign-on-fees as we have people that looks up to us for survival,” said one of the angry players.
“They promised to pay our entitlements but it did not happen.”
As the tin pain am reach e con pin talk again say, “We are tired of empty promises from Kogi State Government. We don’t think playing league games will be a good option for us.”
Dis players raise mata add say de small tin wai government promise to add for on top dia salaries, be like say e don enta voice level as notin raise till now.

Make we no forget say one time like dat, Kogi State Governor, His Excellency Governor Yahaya Adoza Bello approve N3,980,000,000 make dem run project tinz for first quarter for de state, but yet tinz no de happen reach dem.
As be now “Eyes de look Eyes” for diz mata as we dey monitor situation.