No be small tin ooo for inside Port Harcourt as beta beta star dem appear for inside Ph to jollification witi Rivers pipu, as our ogbonge oga kpata-kpata for Youth and Sports Development for de whole of Naija Mr Sunday Dare finally declare mdoor open for de Real Madrid Football Academy wai dem build for inside Ph dere.
Our Minister say diz school wai dem open so, nah beta road for our pipu to get job do and him de sure say diz school sef go produce sabi boys wai go shine like Modric Ronaldo and Messi in time come.
Our sabi Minister Oga Dare yarn pipu for de opening say ” From time immemorial, Rivers state had a reputation of producing notable people like the Great Jaja of Opobo, Alfred Diette Spiff, Justice Karibe White, foremost viriologist Professor Tam David West, two Sports Ministers Alabo Graham Douglas and Tammy Danagogo.
En talk say for Inside football mattaz doz days Sharks wai don change dia name to Rivers United presently don produce world star players wai sabi ball well well, say diz occasion na occasion to remember for life time oo.
Him continue say “I’m confident that The Real Madrid Academy Ph will produce fantastic players like Paul Hamilton, Adokiye Amaesimaka, Jossy Dombraye, Taribo West, Furo Iyenemi and Nigeria’s most capped player Joseph Yobo. The foundation for the actualisation of this dream has been laid today”.
Na so Oga Minister add tori put say ” Although two Nigerians Emmanuel Amuneke and Gbenga Okunowo had played for Real Madrid bitter rivals Barcelona, no Nigerian has played for the Galaticos. The setting up of this institution could change that trajectory by producing new Ferenck Puskas, Santiago Bernabeur, Raul Gonzalez, Roberto Carlos, Zinedine zidane and Ronaldo.”
Oga Dare give dem mind join talk say diz beta settings wai Rivers do so, go helep add watin Oyinbo de call value to Naija football, say diz Real Madrid Football Academy for Ph wai don stand so, go arrange beta beta developments tinz like education, jobs and sports mattaz growth.
Laslas Oga Minister, Sunday Dare come promise dem say govament thuru Ministry of youth and sports development go arrange support give pipu of Rivers State make dem ministry for de move forward .