Naija sabi striker Taofiq Jubril wai de play ball for senior men league witi MSK Zilina for inside Slovakia dere, don show Oyinbo pipu sotin mega witi anoda burst brain goal, wai spoil ticket for dia opponent wai tink say game go finish well for dem.

De kaduna base pikin just scatter last minit joy for dia opponent Sparka Trnava wai ti say away tiri point don de sure for dem as dem bin de lead witi 1-0 wai dem score for 49mins until super sub Taofiq enta for 55mins sharperly change am for dem witi beta equalizer for 88mins to Makam 1-1.

Matta no still end there as en team Zilina begin get more ginger to take press dia opponent like fresh Ghana buns tili Trnava player F. Twardzik come do own goal issa goal for extra time wai come favour Zilina Naso game end 2-1.
As www.queenkada.com.ng Tori pipu ask am for one on one tori chat, how en feel as de dem grab de tiri ponkwe for last minit, na so Toafiq ansa witi laff say ” Diz nah very joyful matta for us, no be only me ooo, but all our team join, doe de match bin wan look say e go tie wrapper against us ,as dem bin de lead us for second half witi 1 goal Kai!! De tin touch me, I just tell myself Immediately I enta field as sub, say I go try all my possible best make I score to helep my team grab point back, na so opportunity enta for me, I no even think am 2 times
Na so I fire de ball enta net wai come balance am 1-1 for us.
De former Valadares Gaia FC of Portugal striker come still add small talk join say, ” Na team work make diz victory happen for us, i de thank baba God say our opponent no follow us share diz tiri point, as dem use Dia hand for last minit wai we press dem back to back, dem do own goal wai favor our govament , as e be so for me, nah to continue to de work hard and put more strong strong effort for my game, to make sure, say i make everybodi proud especially my Naija pipu, him close talk.
Right now en team MSK Zilina don Sidon for numba 3 witi 40 ponkwe on top senior men league table wai dem call Slovak Super Liga , While pipuNaija striker Taofiq Jubril wai de play ball for senior men league witi MSK Zilina for inside Slovakia dere, don show Oyinbo pipu notin mega witi anoda burst brain goal, wai spoil ticket for dia opponent wai tink say game go finish well for dem.
De kaduna based pikin just scatter last minit joy for dia opponent Sparka Trnava wai ti say away tiri point don de sure for dem as dem bin de lead witi 1-0 for 49mins until super sub Taofiq enter for 55mins sharperly change am for dem witi beta equalizer for 88mins to Makam 1-1.
Matta no still end there as en team Zilina begin get more ginger to take press dia opponent like fresh Ghana buns tili Trnava player F. Twardzik come do own goal issa goal for extra time wai come favour Zilina Naso game end 2-1.
As www.queenkada.com.ng ask am for one on one tori chat, how en feel as de dem grab de tiri ponkwe for last minit, na so Toafiq ansa witi laff say ” Diz nah very joyful matta for us, no be only me ooo, but de our team join, doe de match bin wan look say e go tie wrapper against us ,as dem bin de lead us for second half witi 1 goal Kai!! De tin touch me, I just tell myself Immediately I enta field as sub, say I go try all my possible best make I score to helep my team grab point back, na so opportunity enta for me, no even think am 2 times Na so I fire de ball enta net wai come balance am 1-1 for us”.
De young striker come still add small talk join say, ” Na team work make diz victory happen for us, i de thank baba God say our opponent no follow us share diz tiri point, as dem use Dia hand for last minit wai we press dem back to back, do own goal wai favor our govament , as e be so for me, nah to continue to de work hard and put more good effort for my game, to make sure, say i make everybodi proud especially my Naija pipu”. Him close talk.
Right now en team MSK Zilina don Sidon for numba 3 witi 40 ponkwe on top senior league table wai dem call Slovak Super Liga , While pipu wai dem beat Sparka Trnava de follow dem for back witi 35 ponkwe.