De Coachito of JVC Volleyball Club of Bauchi don drop yarns say dem wan gain promotion inside Naija volleyball Premier League.
Dada wey tell tori pipu for inside kaduna afta dem finish 3-1(25-23,25-21,28-30,25-23) over Oyo state for 2021 National Dvision 1 volleyball league wey still de go on for inside Ogbodo Kaduna for Wednesday.
Coach dada release talk to Tori pipu say, “JVC of Bauchi is in the Division 1 league to gain promotion to next season’s premier league because that is where the big guns are and that is what we are aiming for. We do not expect anything asides from getting the ticket”
Na so en say, him de very Ok witi en players performance as dem tackle Oyo state.
Dada cum admit say technical errors, make dem no fit do Kwara strong tins for dia las match but en don promise say dem no go do all doz yeye mistake for oda matches.
Him add talk join say, “I feel happy winning 3-1 against a young Oyo state side because we worked hard for the result and we thank God for the victory recorded.
Laslas coach Dada close Tori say “Losing to Kwara United on Tuesday was a technical error from my side but we did our best considering our situation. I believe my boys played very well but it was my fault we lost but I am working on it and we are going to get on top on this matter”.
So far, make una take eyes take follow Day 3 results
Spartan Spikers of Yola v Kwara United 2-3 (21-25, 22-25, 25-17, 25-21, 12-15)
Kastina United v Caliphate Spikers of Sokoto 3-1 (25-23, 25-19, 22-25, 25-12)
Oyo state v JVC of Bauchi 1-3 (23-25, 21-25, 30-28, 22-25)
Kada Kings v Equity Spikers of Kebbi 3-0 (25-14, 25-15, 25-14)