Kano Pillars senior man, Nyima Nwagua don say en team no dey fear de face of Akwa United coachy Kennedy Boboye atal, as dem ready to scrape promise keeper hair for inside NPFL MatchDay 27.
Make we no forget say, Kano pillars bin collect beta beating from Rivers United hand for match wey end 2-0 for dem inside NPFL MatchDay 26. Senior man Nwagua sharply clear talk say as be, Kano Pillars go comot strong gidigba take arrange Akwa United as dia plan na to revenge wetin promise keepers do dem for first leg wey dem loose 1-0 inside Uyo.
Na so e nack tori pipu Oyinbo say “First of all, I will clear the fact of watching our game, you have to know that sometimes your away strategy is different from home system so watching our game has no difference, we will still maintain our home record and keep our head focused.”

E come add talk join say “Right now, we are not taking about the one that has passed, we are actually focusing on the one that is coming so his presence has nothing to do with us because we want to win the league title besides he got his 3 points at home so we want to do the same”.
As Kano Pillars neva lose since NPFL Matchday 1 tili now for dia house, make we see weda Akwa United go change am for dem inside Ahmadu Bello Stadium on Sunday.