Naija skillful midfielder Benjamin Opeyemi Teidi don prove say Naija pipu no de carry last at all, as en be like star wai dem arrange Duracell battery put inside make e for de shine well well.

Ope as our Naija pipu de call am, de play for senior men club wai dem call am Dinamo Batumi for inside Georgia. Ope don spend over 8 years for inside Ogbodo oyinbo de play beta senior men league, witi Europa league many, many times witi different club.
Opeyemi wai be beta midfielder wai de score goal join, still prove en sef for dia last game as e stand gidigba for Dia match against Dinamo Tbilisi as en club come use full chest collect 3 tiri point for dia opponent hand, for match wai end 1-0 for dem Ope favour.

De away win sweet em belle sote en enta en social media go write say :
“Olorun t’ape t’o nje 💎
Massive win,
strong performance from the team and amazing support from our fans 💙.”
De before before player of Liepaja FK of Latvia reason am well say e no easy to grab tiri ponkwe from away ,na so en sharply show love and troway salute give pipu wai support en govement.
Witi dis new tiri point Dinamo Batumi don sodon top of league table as number 2 witi 7 points for de now.
Nice write up, keep the good news flowing. More grease to your ogboge pen