Super Eagles striker, Gabriel Okechukwu don sign correct ogbonge 2 million dollars deal with Japanese club wai dem call Consadole Sapporo FC for de next 4 years.

De 25 years old goal machine wai start en football waka with Water FC for inside obodo Abuja bin tap leda for Akwa United dem for 2017 before en come waka go Wydad Casablanca for Morocco after one year.
De ogbonge playa bin also play on loan for one Moroccan club, SC Chabab before en pack him load waka enta Wydad Casablanca as free agent wai en com see opportunity sign diz mega deal for Sapporo in Japan.

As e be so, many pipu de hope say Gabriel Okechukwu go helep en new club try win dia league or better still make dem grab continental ticket and domestic cup dis season .
Laslas as mata don be wey Gabriel don change base, e de record say na him luck don push am to be first Naija player to collect better moni to play for Sapporo FC in Japan.