De Ogbonge Govanor of Kogi State Yahaya Bello don carry en whole mozule take support diz grassroots basketball fiesta party wai dem wan hold very soon inside en kaba ,Kogi state.
De Before before ogbodo oyinbo Naija basketball player Samuel Oguche don arrange correct yarns kip ,say diz basketball fiesta matta eh, nah serious beta door wai go open for good tinz to enter as de basketball camp go teach young pipu culture of basketball and oda sports mattaz inside dia confluence State.
Oga Oguche use en church mind to tell pipu say Govanor Yayaha Bello do well as en use en inner eyes take arrange and arrange diz correct project wai go bless plenty young young pipu of Kogi State. Oga Oguche Still beg all de chairmen for de state make dem Comot put hand togeda support de govament for diz project make tinz for blend well , Na so Oguche con yarn tori pipu say :
“I will like to commend the Governor of Kogi State for this smart move because that is the best legacy any government can give to the youth”.
E still take mouth add talk say, “Going back home and being part of history is a big thing for me. I will like to thank His Excellency, Governor Yahaya Bello for his continuous support to sports and youth development”.
Dis Kogi State Basketball Fiesta wai join body witi Sam Oguche Foundation de come hot hot so, go be talk of de town for inside Ogbodo Naija.