Naija don finally become champion diz time for 2021 Turkish Women’s Cup afta dem disable dia old rival Equatorial Guinea witi 9 kpondo for las match to take carry de cup.

Na so Asisat Oshoala and Glory Ogbonna wai clear Equatorial Guinea eyes witi beta party jollof hat-trick wai make brain die, Uchenna Kanu, Charity Adule and Oyinbo Naija Toni Payne log on beta ogbonge goals as Falcons con de lead movement witi 7-0 around 43 minutes plus de 2 penarariti wai Barcelona star Oshoala convert to goal for us.
New falcons pikin , Gift Monday for 69 minutes look am say e no go good like dat make she comot field empty no register her name too, na so she dash equatorial babes one goal join de one wai dem don gada for basket to make am 8-0.
Make we no forget say diz same Equatorial Guinea don been win women African Cup of Nations two times, but bad as e bad for them now , dem still need to try win 7 more times to reach Naija levels.
As 85 minutes do, na so African best Queen of Goals Oshoala close church service for Turkey witi one for de road wai con kuku make am 9-0, na so referee con arrange whistle blow for 90 minutes.
Chaii!! Na small tin remain make Naija babes for spell Equatorial finish put for de matta.
As e stand so, Naija Super Falcons don become de first African team to win Turkish Women’s Cup since dem start am.