Home Beach Soccer Jollification Promax As Sand Eagles Don Return Back To International Setting

Jollification Promax As Sand Eagles Don Return Back To International Setting

835
0

Jollification don bust comot inside Nigeria Beach Soccer Terrain as draws show say dem go battle with Mauritania for de qualifiers for 2024 Beach Soccer African Cup of Nations.(AFCON).

De draw for Beach Soccer African Cup of Nations Egypt 2024,been hold For CAF headquarters inside Cairo.

As e stands so Sand Eagles don return after 5 years plus to international settings as dem de prepare to tackle Mauritania people for qualifiers inside dis year July.

Make no forget say one time NFF for 2019 under Amaju Pinnick make up en mind with full chest say make all man go en house, say dem no do Beach Soccer again for NFF na like dat Sand Eagles future come take scatter that year ti now wey hope don arise again.

14 teams na en go enter show down for dis qualifiers, inside na Angola, Burundi,Cote D’Ivoire,Ghana, Guinea,Malawi, Morocco, Mauritania, Mozambique, Nigeria, Senegal, Seychelles, Tanzania and Uganda.

Qualification proceedings dis time be one round movement, na play for house and play away basis, na from there dem go know de 7 teams wey go join pharaoh people (Egypt) wey be host for the finals.

Make una use eyes take check qualification rounds dates :

1st Leg: 19-20 July 2024

2nd Leg: 26-2024 July 2024

LEAVE A REPLY

Please enter your comment!
Please enter your name here