Home Beach Soccer Jollification Promax As NBSL Release Team Of The Season

Jollification Promax As NBSL Release Team Of The Season

450
0

Jubilation yakpa as five players from de 2023 Champions of Naija Beach Soccer League (NBSL) Kebbi Fishers Beach Soccer Club name enter inside team of the season wey dem just release hot hot on monday .

Dis na dey first time wey de don eva arrange dis kind of tin since wey dem start NBSL, de Technical Study Group (TSG) of Naija Beach Soccer use beta time take check and select players based on tactical doings for matches wey dem play and dia important use for inside dia different teams to take judge dem.

Inside de team of de season matters, dem no leave oda teams make e be like say dem be outcasts for inside de league, naso dem name tiri players from Kebbi United, Nmanko Patigi and Kada BSC come get two two players each wey dia name enter de list too.

Coach Bashar Samaila Oga boss wey teach Kebbi Fishers team watin dem take win de league, get two players for inside starting five and tiri players come from bench take enter de team.

Dem come vote goalkeeper Godwin Tale of Kebbi Fishers as numba one choice for goalpost affairs,bcos en do plenti strong saves for matches wey dem play for tro out de league, na only him among goalkeepers no chop goals plenti for de season, na so Godwin turn defense coordinator de arrange en defense line make shame no for catch de whole team for matches wey dem play.

Naso dem add mad combo for attack as dem name two dangerous attacking marshals for de list Adekunle Jamiu(Nmanko Patigi BSC) and Dozie Frank (Kada BSC).

Two players en comot as highest goal scorers ,Dozie Frank wey don collect am back to back for NBSL score 16 goals dis time , while Jamiu score 11 goals for kwara BSC team.

Dem no leave bench empty like dat, as dem add substitutes for de list,make de love for de game go round, dem add tiri players from Kebbi Fishers,Arome Isah, Hassan Muhammad and Ekene Obi, Ogunlana Seun(Nmanko Patigi BSC), Victor Tale( Kada BSC), Usman Bello and Hamza Manga (Kebbi United BSC)

Dem come make Coach Bashar Samail commander-in-chief as dem call him name as de ogbonge coach of the season,make we no forget say inside tiri years wey NBSL start coach Bashar don carry de league title two times.

LEAVE A REPLY

Please enter your comment!
Please enter your name here