Home Pigin ANFSC do give away as dem visit orphanage

ANFSC do give away as dem visit orphanage

98
0

Authentic Nigeria Football Supporters Club, de numba 1 supporters club for Naija don touch de heart of plenty plenty people dem as dem go visit Hearts of Gold Children Hospice orphanage home for Lagos .

This kind better waka na watin ANFSC de do every year as normal to take tank baba God for many many beta things en don for dem tru out last year wai things bin get K-leg bcos of de Corona Virus mata.

As de ogboge presido of ANFSC Prince Abayomi Ogunjimi dey yarn wit tori people talk say:

“Nothing gives me joy like seeing smiles on the faces of the needy and less privileged in the society”

Presido Ogunjimi wai be man wai get soft spot for less privileged dem no dey ever troway eyes go far wen e reach mata of helping people especially for diz time wai tinz de red for all man, en com add talk say:

“We have had a rough year due to the pandemic and we lost a few prominent people in the Nigerian football circle so we are using this as a point of contact to thank God for surviving 2020 and also make the children smile as we look forward to a prosperous 2021”

Laslas de the waka com end for dancing and better jollification tinz as the ANFSC band finish work with jaration songs.

LEAVE A REPLY

Please enter your comment!
Please enter your name here