Home Refereeing NPFL MatchDay 18: NRA Don Show Dia Red Eyes for Tiri Referees

NPFL MatchDay 18: NRA Don Show Dia Red Eyes for Tiri Referees

89
0

Naija Refeere Association (NRA) don come out to show pipu say dem no de do pasha for any complain about any yeye officiating matta wai reach dia domot .

NRA wey take time de look evidence well-well come nack tiri referee out of four of dem wey officiate Kano Pillars vs Heartland FC for MatchDay 18 beta short time suspension as dem de look into de matta de go.

NRA wey release official talk for social media tru dia national publicity secretary, Kelechi Mejuobi yarn sayn

“I have been directed to inform that the following referees who handled the Kano Pillars vs Heartland FC In Kaduna have been temporarily stepped down for future appointment pending the outcome of their appearance before the NFF Referees Committee concerning incidents connected to the match”. The referees are; Salihu Tatabu NG, Ibrahim Tikau YB and Felix Ogundiran OY, Kelechi concluded.

Witi diz kind ogbonge new development magu-magu tru whistle and flag go reduce as NRA de make sure say every tinz must work well diz time around witi de league

LEAVE A REPLY

Please enter your comment!
Please enter your name here